Africa; The Place Where Dem Born Pikin Of Civilization (In Nigerian Creole: Pidgin English)

in #pidgin-english7 years ago

The total SBDs wey go come outside from dis post, I go transfer am enter the account of @genesis-project (dis na one of the projects wey dey inside Steemit In Nigeria, S.I.N)

____________________________________________________________

Ehen, my people I don show. Make I bring una tori wey relate to this our ogbonge continent wey be Africa. 

Before I carry my tori proceed, I wan tell una dis: na for inside Africa wey human evolution take begin. Na archeologists and Paleoanthropologists wey package dis brain give us. As dem confam am through carbon-dating, dem talk say the earliest humans na for inside Africa ein exist. 

[Image Source]

Dat mean say: The first human wey waka on the face of this earth na black man ein be oo (no be talk am, na archeologists talk am)

E get one better discovery wey Oga Leakey and ein wife make for inside Olduvai gorge wey dey inside Tanzania, dem discover say na for here dem born the pikin of our ancestors (Homo habilis). E don tey shaa. Na over 1.9million years ago. No be only Tanzania wey get old fossils, even Kenya and Ethiopia join body too.

I troway salute give scientists and archeologists for this better brain wey dem package give us. Even oyibo dem don confam am say na for inside Africa evolution begin.

Now the question come be dis:

If oyibo dem don accept dis fact, wetin make us no wan accept say we dey superior? Why we dey see ourselves as inferior? Chai, dis kind tin no make sense at all oo.

Africa no be only the birth place of civilization, but na for inside Africa wey technology take begin. Africa make sense no be lie.

As I wan carry my kaya waka, I wan tell Africans dis (But I go speak am for English shaa)

There is glory in being an African

Una Weldon oo

_____________________________________________________

Make una remember say S.I.N na tomorrow oo

Sort:  

hahhaha @samminator your head correct. No be lie ooo say glory dey Africa, If you check am well sef, you go notice say we carry glory enter steemit. Thank you jarey, i gbadun your tori. i no sabi say u sabi speak #pidgin-english like dis, Sotey you com fit carry am teach us science 😃😃. Make i resteem am

If you check am well sef, you go notice say we carry glory enter steemit.

I swear. D glory no be small oo.

i no sabi say u sabi speak #pidgin-english like dis

Omo, na we get pidgin naa. Pidgin make sense die.
I troway salute give you bro. Ur ministry go move to permanent site

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 54414.30
ETH 2295.54
USDT 1.00
SBD 2.30