Your future na now. Another Patient Dog don die

in #pidgin-english7 years ago (edited)

PicsArt_10-30-10.03.22.png
Dem say na the dog wey get chill dey chop the meat wey big pass.
E depend ooo, Patient dog go dey one side dey look, all the dog wey dey sharp go finish all the better meat wey dey for pot.

So wetin i dey try talk be sey, make you try plan your future well, Make you no dey over depend for one thing.
We sabi say no body know wetin tomorrow fit be, we know say blessing fit fall ontop us at anytime, But make dat one no make us waste any small chance wey come our side ooo.

Dem say dat one bird wey you hold for hand now betta pass all the bird wey dey inside bush

So anything wey u dey do, make you dey am well.
If you neva get wetin you dey do, find betta thing begin do.

@ionlyspeakpidgin thank una well-well as una commot time read wetin him talk.

If you gbadun my talk you fit just dash me your upvote, Make our ministry for dey move😀

Thank you

IMG-20171012-WA0016.jpg

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 54414.30
ETH 2295.54
USDT 1.00
SBD 2.30