@surpassinggoogle ask Who i be?? : No tallent, as everybody na winner.

in #pidgin-english7 years ago (edited)

PicsArt_10-12-11.47.15.png
My people! I no sabi wia i go start from as i still be new comer for hia, and i still dey learn am small small.
My steemit name na @ionlyspeakpidgin, my real life name come be Mr Jim Uche.
I been don talk about my self for hia before, see wia i for talk am here

As i dey flex my self for steemit inside our nigeria tag, I come jam one post like dat wey @dayjee post wey he call UNTALENTED: Who is dayjee? As i read the guy post finish, i like am come drop coment for am. before i go know i done get many reply from men dem, even @surpassinggoogle self reply me, say him self go like make me self join he noTallent contest.
Screenshot_2017-10-13-00-22-12.png

I happy wella, because me be no kno say plenty opotunity like dis dey hia. So make i drop my own now.

Who i be? @surpassinggoogle dey ask

Where i from?
My people, i from Africa.
The Africa wey born Nigeria wey be the giant of dem Africa, the giant of Africa dem come born me.
So i dey proud wella to come from nigeria. We no dey carry last for any thing wey we wne do, we dey comot from nigeria hia enter oyibo man land go still follow dem drag first.
If u be naija, upvote dis post one hand.

Where i school reach?
My brother! If i tell you say e no easy for me no doubt me ooo, As na me be d first son inside 6pikin dem. Am my papa dem no carry plenty bar, na 0 level i stop.
Hope still neva end ooo, if i begin get better pay, i go chook head for national open university.

Wetin i dey work?
My brother! for get Giant of Africa matter ooo, Thinx still hard here oooo, but no le-le hungry no dey near me.
I neva get daily work or office work, But Hustling na our motor, anywia he carry us enter we go chook head.
Na the same motor carry me come steemit.

Wetin i like?
Hahahhaha! i like play wel-wel. Anything play. i carry am A1, from small pikin. kpakpangolo, super-mario, mama and papa play, ball, funny gist dem, playstation game, boris, if i begin metion all of dem we no go reach wia we dey go.
Jus call me play-play.

Wetin i no like?
I no like fight atall.
I no like to dey form, or wetin dem dey call acting bigman.
Jus simple and tall

Why i carry pigdin enter steemit?
I don waka inside steemit, i come notice say no be wetin dem do copy-copy, or form wetin u no be.
As i no sabi blow big-big grammer, e better make i dey do wetin i sabi.
One dey oyibo peson fit learn atlist one pidgin word from me. Na him be say person done still learn from me.

E be Like say we go stop small here

Thank you as u comot ur time take read dis my post

Make i use dis opportunity holla dem boss wey dey support me, comot cap for @ogoowinner @ogochukwu @churchboy @infovore.
IMG-20171012-WA0016.jpg

Upote am if u like d post

Resteem am make ur padi dem fit see am

Follow me if you like me

Steemam as e dey hot

Sort:  

Area!!! I hail you Baba. What's d level Na? How yonda for upland. I troweeh Salut for this ogbonge niche Wey u don drop for #Steemit.. Even @surpassinggoogle don confirm ur matter. Anyhow sha, e good as u don yarn us who you be. I go corner you for one side later. .
Na Minnow Wey wan turn whale
@michaelcj

Area, u dey every corna.
U don get levels wella for here, come still gather many men dem join steemit.
I dey hear your scores.
Make i run follow u

Abeg Bros your talent dey too much, carry dey go, e no easy make man pikin to dey speak Pidgin English wey everybodi dey blow grammar. No be small thing, I dey trowey salute.

Na the koko be that, to dey speak only pidgin no be beans :)
Ask any pesin wey wan try am. Lol

Bros, see as you come dey make me get levels for yonder. Shooo. As you dey mention me join all these big oga dem, I come dey feel like say I follow. I hail you pass.

Bros, na the koko be that. BTW I just love your posts. The last one just inspired me to write something nice and to change my approach to certain things. Thank you for showing us the original, no be photocopy!

@churchboy you dne show me plenty love here, u follow for my boss dem

Why I no go love you my brother? I sabi book nah :)

Greetings Oohh. Na Wetin Wetin we dey find be this. Followed and Resteemed

how una dey @ionlyspeakpidgin

omo see how ur pidgin fluent pa, u even confirm am say naija no dey carry last anywhere we be, na confirm word be dat

sha dey steem on and dey ginger us, no be only salute i give u, i give u more sef.

na ur boi o @valchiz

I swear una dey give me joy, as i dey read una coment.

@ionlyspeakpidgin,
Oga boss, i gbadun dis your article, i just dey smile as i dey read am,
im be like say na from warri you come from?
Carry go boss.

I gbadun you pass, as you join read my post. I dey happy hia.

Lol. My countri pipol, this our own here oo. This niggar get better talent no be small.

Oga well done sah.

@gunneresq. you dey make me laff, i neva see my talent oooo.

Lol. Oya make we join hands find am.

I dey hail ooo...! U do well to use pidgin-english dey write. As dem born me for Delta State for Naija, ne pidgin-english we dey take run things there. So, bros. I like pidgin. Na so so laf, I just dey laf wen I read your post. Abeg, u fit dey do podcast for pidgin make we for know wetin dey happen for ur area? U fit use dsound. Dem go roger u 25% sha. How u see am?

Lol. Hahaha. This roger no b small o. This pidgin dey sweet.

How far na bros, @turpsy? I hail ooo...U sef don show for here? No be lie, the roger no be small. Naim make sometimes, if I think am, I go just tell myself say e better make I first upload my work for soundclound/youtube . After I go come put am for steemit. Na so. Well done, bros!

@maryfavour.

i don hear anoda one! dsound.? i go check am see thank you

No kain, bros, @ionlyspeakpidgin. Carry go!

@maryfavour una love too much hia ooo.

oh boy! dis is cool ma man! Neva heard dis before.
Is it Creole? How You Dey? . I no sabi.

Remind me of Bahamian english!

It is Pidgin English, Nigerian version. As the name implies @ionlyspeakpidgin :)

thank u, very interesting!

wait ooo @sunnylife i no come undastand u ooo. so u sef sabi speak pidgin?

I no sabi man. wat u talkin bout.LOL
I no no. I want to learn:):)

@sunnylife u mean am? follow me na make we dey yan. i gbadun you

I like u. Ur real! ur ma man!!
@amec is going to teach me some:)

Hm,, you be beta person, e good as you follow for this contest so,, abeg mae you teach steemians pidgin wella o,,, you dy try,, Tuale baba✌👍

@tony-duke i thank una ooo. I sabi say steemit sweat like dis.

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 54414.30
ETH 2295.54
USDT 1.00
SBD 2.30