From Ponzi To steemit: See How ponzi take bless me

in #pidgin-english7 years ago (edited)

My people, i greet all of una wey dey read my post. Una Happy Sunday ooo. I pray for church today make blessing and plenty SBD dey fall untop us like Rain. Make badbelle people no enter steemit. Amen.PicsArt_10-29-12.05.18.png

My talk today Na how ponzi scheme take bless me By that kind April last year wey i just dey, dey reason how boy go be man, i come recieve phone call from one of my friend wey dem dey call ifeanyi.

Me: Helo
Ifeanyi: How far na?
Me: I dey, wetin dey happen, dis one wey you call me
Ifeanyi: You done join m.m.m?
Me: Wetin be M.M.M?
Ifeanyi: Oboy you dey miss ooo, na m.m.m dey pay me now ooo. Oboy i be big boy now ooo.
Me: See levels, Abeg gist me i dey interesting
Ifeanyi: M.M.M na online business wey be say if u come am now dem go pass you person wey you go pay, if you pay if he reach 30 days dem go pass you the person wey go pay you your money with 30% jara ontop.
Me: You mean am?
Ifeanyi: Yes all my guys done blow, come join us.
Me: O.k make i reason am i go call you back.
Ifeanyi: O.k reason fast ooo. byebye
Me: byebye my man.
we cut call.

After we talk finish i come begin reason the matter ooo.
I reason say how come i go pay people wey i no sabi money, if dem no come pay me my own when my time reach, who i go hold?
I come reason again say 30% of 100k na 30k go be the person gain.
I come reason again say 30% gain too small for me to risk my money for wetin i no sure for, for 30 days. Atlist if na like 1hrs, I fit manage am small that 30days dey me like 100years.
As i reason am finish, I come comot mind from that kind business As sharp guy wey i be.
As he nack 2weeks Ifeanyi call me back say how far i no give am reply again, i tell am sey i know like dat kind business, he begin confuse me again i tell am say make i check am again. the boy begin disturb me for whatsapp and call, I no know say na refferal bonus he dey find for my head. I still no gree

He come nack October last year na him another of my friend wey he name na livinus come meet me say i done hear latest business, I ask am say na M.M.M? he say no, say dis one na ultimate cycle. Make i bring 12,500 say b4 14 days i go get 50,000.
I still dey reason am another friend (Victor) come meet me say i dne hear icharity.club ? Say na only 6,000 i go bring, i go mke upto a million with am. I ask only 6k? he say yes.
Na him i carry 6k give am make he register me. He come teach me strategies wey i go take dey catch people wey go dey pay me. I grab am, run open facebook advert and whatsapp group as sharp guy na.
Before 2weeks i run make like 300k from icharity.club my guy ifeanyi neva make dat kind money from M.M.M.
icharity experience carry me enter many ponzi wey pay me well-well, carry me enter paycycle to smile2charity to mycharityloan to tetrismart to bigbankalert to many as he dey hot plartform wey dey crash b4 24hrs.
I enter ponzi with only 6000 naira come take am make 4,000,000 naira, the same ponzi come dey swallow the money back small-small, come swallow upto like 1,000,000 naira back from the 4,000,000.
Na that time i begin notice say water don dey pass garri like dis ooo if i no take time dem go swallow the money back.
Friends wey i make for ponzi group come introduce me to Crypto Faucet, from there i come begin get idea of cryptocurrency na the same group wey @detycoon with @daveobada take introduce us to steemit but dem latter quit as dem notice say no be as e dey hot ponzi.
I Thank God for @surpassinggoogle dem @ogoowinner dem @churchboy dem @ogoochukwu dem as dem dey surport and encourage me.

I Sabi say ponzi chop many people money, send some people back to village, make some people idiot, still make people rich, I swear he make my account dey smile, as i dey talk now ponzi money buy me brand new bike, open small provision store for me, still keep change for my account.

Ponzi connect me to the World.
If ponzi chop you no vex Na person dey pay person money
Anything wey you wan do for this life make you reason am well no allow person use your head.

Thank you as you read am.

You fit support me if you enjoy my tori with upvote and reply.

Thank you
IMG-20171012-WA0016.jpg

Sort:  

hello @ionlyspeakpidgin

Baba I hail o, I dey believe this your style very original.

Oshey tuale... Hope say hin dey make sense for here.

Your ministry go blow o.

I be your fan.

@dante31

@dante31 i thank you well well.

Omo, so u follow do dat thing? U lucky say d ponzi no crash ur economy. Anyway, all na experience shaa.
Bros, ur ministry make sense die, I swear

@samminator i follow do ooo, na him even expose me come steemit, the thing favour me well-well