Making the steem social network better-Delete and block button needed

in #npc6 years ago (edited)


My fellow people, how una dey? I hail una.
As I see this post by @ogoowinner I say I must shook mouth put for inside the matter wey dey ground.
When I join this ogbonge platform, I no notice say the delete button no dey o and I no mind at all as all the comments dey sweet me for belle. I mean una don see my intro post?
Something con happen wey change my mind, the thing vex me well well. E get one of my friend like that o.. I swear say if person tell me say im go fit do that kind thing ehn..I for say na correct lie. E get one post wey I put. I make mistake for the post as na the first time wey I dey enter the contest.
Person wey organize am put comment to correct me and I take the correction o. Na im the person wey I yarn una about carry him leg come my post type one kind harsh comment for there. I try to delete am for where, I no see delete button for there. The comment pain me o maybe na because say I no expect that kind thing from am. Anyway,na so this life be but make we try to dey show each other love as nobody dey perfect.
E get another reason wey we need the delete and block button o... imagine say you post something now,go relax come back to read wetin people reason about wetin you write,you see 10 comments for there..body don dey sweet you only to open am see say na people wey dey advertise their contest and referral link and dem no upvote the post o. Wetin dey vex pass be say no be one time dem go send am,dem fit send like four.
As my rant don end so, I hope say people wey dey in charge go consider to put the delete and block button for the comment section.
Wetin una think my people? I yarn well abi I no yarn well?
@ogoowinner you do well o.. I no even know say I fit write pidgin like this as na the first time wey I dey try am. Three gboza for you.

Sort:  

My sister from another mother. See enh, u too try, in short enh, over try dey worry u. See as u take use my malee tongue take open waiten really dey pepper u for mind. See eh, 15 gbozza for only u, no share give another person o. Body dey tell me say na my person from Edo State from our obodo Nigeria u be. Make I shut up my mouth make e no do u like to delete my post. I take all my body plus including my heart take support waiten u talk. Those two bottoms way u mention so enh, we need am. Before e go b like say I too dey yan, I don up vote u before I write dis my long love letter. I go drop my golden pen for ur basket of love. I don dey follow u, make u do too. Goodbye.

Lol.. thank you o. I don dey follow you too.

Thanks too o. Anywhere u see my post, Judiclearity, pls dey up vote me o Luice. U don meet Steemit husband o.

No wahala

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.13
JST 0.027
BTC 58986.04
ETH 2580.24
USDT 1.00
SBD 2.53