Creed Of Life... Naija Pidgin Challenge Season 3..

in #npc7 years ago

Naija una wehdone ehhhh

Make I start de hailing from we seat of Power ooo, oga Muhammadu Buhari, how your life de hope say mama Aisha de give you joy?

Abeg before I forget, munna help me give better shout-out to my steemit mama, mentor, Abi maalee, I no mean another man pikin, na @ogoowinner I de talk for this big time contest wey she carry come to take make we smile small for this we Naija.

She say may we gist about creed of life and I want talk about no other pelson pass my mama @ogoowinner.

For this our world wey plenty bebs no get time for hardwork again, few of them still de wey no de put eye for man money, one of them wey I sabi na @ogoowinner...
See wetin the beb ds take her hands do carry chop,

DQmRwfp8MdrfDs8vrZrvEUksN4HB47NPMsGCm765PcYmvdH.jpg
@ogoowinner handwork

She no de for lazy man parole at all, na im make she come join STEEMIT again dear write, na complete hustler @ogoowinner be, for most of us wey no sabi the beb, she be Ogochukwu Emmanuel from Eastern Nigeria, she don pay her dues and loyalty for this we steemit, she don struggle, but wetin I like for am be say she no de gree give up...

Screenshot_20180129-225523.png

Na her first Post for STEEMIT be this, Biko no laugh, she been too try, I gbadu for the babe wella, if you look her blog today you go know say she no de like give up anyhow .

My own **creed of life be say, for this life, anything you say you wan do, you go do am!
She been say make we upload picture of one fine Nigerian, abeg na who fine pass @ogoowinner?
Them no born that kind person.
U5dszXhPgvUofTPPVvw3Y1aoTU99UgX_1680x8400.jpg

You do well for this contest ooo @ogoowinner, I throwaway salute give you ma.

#twale 🙌

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.030
BTC 65540.54
ETH 2608.45
USDT 1.00
SBD 2.65