WE NEED THE BLOCK A.K.A GBOSA BUTTON- #NpcsteemCreated with Sketch.

in #npc6 years ago

Today tortori na say we need the block a.k.a gbosa button.

Screenshot_2018-02-08-07-09-43-1.png

Our sister @ogoowinner don talk how person wan carry her do yeye because of say she come out come dey beg people make them follow her help and support person wey dey sick cancer.
If to say this GBOSA button dey for here so as e take dey for other social media she for just jejely block that man so that she go get her peace of mind.

WETIN MAKE WE NEED THIS BLOCK A.K.A GBOSA BUTTON
Abeg !!! Na beg we dey so, make una help us add this block button for here so that person go fit get way to feel like say the blog na truely him owm, make e fit controlled wetin dey goes on there.

WHERE THIS BUTTON SUPPOSE DEY.
We go like make this button dey for person reply, so once you just see any body wey dey yarn nonsense you get the right to commot am.
We go also like make e dey for people post them because 419 people go just dey use the opportunity to dey put the same thing plenty times

Make una hear us so,so that we go fit dey commot all the bad belle people wey no want make we go higher and wey wan put sand sand for other people garri.

THANK YOU!!

The fine man wey dey there so na FEMI OTEDOLA.
OTEDOLA WITH THE MONEY!!!!!

Coin Marketplace

STEEM 0.19
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 64015.61
ETH 3429.88
USDT 1.00
SBD 2.54