IF YOU GO VILLAGE MEK YOU NO GO SHOW YOUSELF OOO, OR GO DEY DRAG LAND WITH WICKED UNCLE; WHITE TEETH NO BE WHITE HEART!!

in #naijapidgin6 years ago

GOD DEY OOO, MAKE UNA HEAR AM WELL - WELL

PhotoGrid_1527806821348.jpg

NA ONLY GOD SAVE US FOR DIS MOTOR JAM

Anybody wey talk say God no dey, don get asagbodo for lie, because if e no be God, I for don dey sing another evil song now.

Person wey talk truth, e don do bad thing?..

This one na tori for wetin wey happen to me for village, wey I say make I go check people wey e don tee wey I see dem last.

Wetin I no no, no go chop my head oooh!

Wetin carry my leg enter that village hall wey old men dey dey, I no no. Like fowl wey don lost hn way, that day I waka go find wahala for where stretch leg dey sleep dey snore like pig, one man wey say he no go gree for the land wey our papa die leave for us, village people don gather dey talk em how e go be, when I enter and wetin dem dey talk no sweet my mind at all, na eh I carry hand up say I get wetin I go talk, one inside the old papa come say make I stand up and talk my mind,

As I come stand up, I talk my mind say before my old man kaput, he no talk anything like say he dash anybody land, so that one wey he say my papa dash land na lie.

The way wey bad bad uncle take dey collect people wey their papa don die, their land hnn e don too much, make government come join mouth for the matter abeg.

So all the elderly people come join mouth together say make he comot hand for the land, na he come gree remove he hand for the land like dem dey carry comot monkey hand for soup before e turn human being owe.

I don dey salute Oliseh wey dey for up, for wetin He do for me, I no no say that my uncle e don baba lowo place make he finish me plus including my family members, but God pass em power.

That my uncle come our house, carry block stand wey chair plenty bokwu for everywhere, he come go, my senior brother come say make he carry the block go keep em well for where he carry comot, na he hand come size strong like iron, he hands no gree swing again, na we come shout blood of Jesus eeeh!...come dey draw till e come good small.

Na for our own land na my uncle want kill us put.

E good like that??

Na truth wey I talk don put me for gbege.

Wetin dey for land wey go make you kill somebody, Obasi wey dey for up, no go gree.

One day dully we must die leave land, for another person, e no good to kill for land.

Naijapigin una dey bring light wey pass full current.

As we don finish everything wey carry me go village, na road I dey, dey come Abuja wey accident come happen for road, wetin be my sin, because I talk truth, God go save me ooo.

Sort:  

Wetin dey for land that will make you kill person!

May God see us through oo! This village people no gree carry last sam sam.

Na God go save us,

God help us.

How far or fast can we walk.

The issue of draging the ownership of a piece of look land and boundaries is a age long story

Yeah, dats true

The issue of draging the ownership of a piece of look land and boundaries is a age long story

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 57975.44
ETH 2289.64
USDT 1.00
SBD 2.46