SEE THE OGBONGE GIFT WEY ALIKO DANGOTE GIVE PEOPLE FOR HIS DAUGHTER MARRIAGE.

in #naijapidgin7 years ago

My country people una good morning o. How una dey? We believe say we country dey do una better for body.

Today na another day and naijapidgin don carry another ogbonge Tori come una domot. You know who Aliko Dangote be? You go at which kind yeye question be that abi? That na because the name na household name.
imagecredit
Na so news reach us say Aliko Dangote pikin wey Dem dey call Fatima marry her heart-throb wey Dem dey call Jamil. The party no be here o. No so plenty money dey fall left right and center. Na the cars abi na the hall ani na the cake abi na wetin I want talk self.

Aliko Dangote na the richest man for Africa and Jamil papa na the former Inspector General of Police for naija. As you don hear am now you don know say no be small pikin wey were agbada dey go that kind marriage.

imagecredit
To make am sweet pass na so Dem package gifts inside smart travelling boxes nak people wey come grace the occasion.

Na wa! This we country sef. Dangote son no dey see person like me marry abi Abubakar daughter no dey see person like you marry? Why rich dey always marry rich?

na @zizymena nak una this one for @naijapidgin.

You go like join us for Instagram were we dey share better gift dey talk better gist? Oya touchhere

image

na @mittymartz na I'm design this avatar.

Sort:  

This man wey she marry self own don better. Chai! See money oo

No be small money my brother

The matter simple na, Oyibo say birds of a feather flock together. You no go ever see Ole fowl dey follow pupuyeke waka

Omo, y me i no go that wedding? This tori don swt me pass food o..
Me self wan marry rich person, i know say i no get money but miracle fit happen sha

😁😁😁😁 laugh want tear my belle

hahaha no worry e go happen, na faith you need @adabless

Amen, my faith gidigbam like iroko tree

Naijapidgin, make una no bring this kind news come my domot again, na watin? Gbedu don finish b4 una dey come tell me, how i wan come take get my package na? Wen una for tell person say gbedu dey ooo, make una go collect una own oo, somtin don finish una dey come tell me.... See as the tin dey pain me for this package wen pass me.....chei!

No vex next time we go let you know on time.

Nawa o see money,thats why the rich go always dey rich.

Why e dey happen like that?

Na only for nollywood rich man pikin dey marry poor man pikin o. And I feel say dem dey see themselves marry because of their circle of friends. Na rich man dey befriend rich man. Dem get where dem dey meet.

Dem really get where Dem dey meet my brother. God go help us.

Boss please voet have me yes, please

No mind them na so them they do, they go dey marry themselves, no worry zizy baby when i don blow i go come marry you asap

Hehehehe okay I go dey wait for you

Afa if we use naijapidgin as tag una go vote our post

Lol, I love your concept bro. Nice one

Have you heard of Stach? If no, visit our discord channel, stach has a lot in stock for you click here to visit our channel.

Coin Marketplace

STEEM 0.18
TRX 0.16
JST 0.029
BTC 64050.44
ETH 2502.78
USDT 1.00
SBD 2.65