Pastor wey dey vomit money

in #naijapidgin6 years ago

Una good morning my country people how una body dey for this our ogbonge weather as our pipo dey call am weather for two.

Today na Wednesday we for naijapidgin salute una well today we don bring another interesting tori come jam una this morning.
IMG-20180919-WA0003.jpg

Source

The mata wey we carry come na about one pastor o wey e name be pastor Andrew ejimadu this man news don cover everywhere for social media according to report this pastor collect one of him member handbag e comot everything wey dey inside come start to dey vomit money put inside, I dey tell una say since them born me I never see this kin wonder before.

One of the twitter users talk say biblically miracles na for unbelievers to believe but as e be say people for church don already accept Jesus then wetin them need na teaching and preaching only, the mata still dey surprise me.

Abeg my people how una see this one una believe say this one na pastor or magician make we see una comments.

Na @rosyblessing bring this tori come knack una.


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! We encourage and support quality contents and projects from the West African region.
Do you have a suggestion, concern or want to appear as a guest author on WAfrica, join our discord server and discuss with a member of our curation team.
Don't forget to join us every Sunday by 20:30GMT for our Sunday WAFRO party on our discord channel. Thank you.

Pastor vomit money... Mhmm na to kidnap this pastor lock am for house o... But why are the children of God so gullible. Jesus was a miracle worker not a magician. They suppose know the difference na

Hahahahahaha

Just passing by!!!

Where you dey pass to?

I knew you would respond.....

Still passing.

The difference is clear......this one na perfect magician. Its just because of the gullibility of our people and our people dont understanding the word of God na dey make Magician in pastor's clothing dey come deceive us. Even for bible when Jesus want pay e task why he no vomit the money. Every body wey go dey go this church na money them go dey pray make the pastor vomit give them(Holy Atm) no be the word of God wey he go better their life them go want hear again. May God have mercy.

Coin Marketplace

STEEM 0.15
TRX 0.17
JST 0.028
BTC 69075.42
ETH 2475.71
USDT 1.00
SBD 2.35