First Question to ask Bobo or Babe
My naija pipu, beta pipu, correct pals, hw una dey.
Hw Monday dey take be, hope say unah put bodybfor business well and then today Tuesday try to finish up watin you start yesterday
personally I de greet una my Naija people e don tay wae I come here ooo...before you ask na mittymartz de yarn 😋
I sure say everybody hustle de do wella. I read yesterday matter wae everybody put mouth yesterday and I come de think about something and I say make I carry the matter come here...
So the matter na say watin be the first question to ask your person for una first date outing..... Me I know some wae funny like
Shey you get boyfriend/Girlfriend ?
Shey you be virgin
Make I shutup hear una own
Oya talk your own for Comment
Na @mittymartz bring today matter jam us
Na @mittymartz design dis AVARTAR..
Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!
Na wa oo virgins plenty for steemit kwa
Even me sef I be virgin
shey you sabi cook?
shey you get girlfriend ni
shey you get beta correct prospects.
Good question
That cook na koko for me
Me I be virgin, I nonokow wetin na Dey talk about
Nai be say my mama na virgin ooo
If you be virgin kwa
Lolss
My own question na
se you get money? hahahaha
Una well done oo, i just they pass by
Bahd child
Me i go ask am to tell me about hersef make i for know how to expand d conversation ..
Lover boy
Hmmmm
Shey you dey capable ni lol
Capable for watin
Na WA ooo
People spoil oooo
I go ask the bebe -shey you sabi cook?
Yes ooo
Who no Sabi cook no b babe oo
ma own go bi when go bi our 1st day way we go lick
Clean your mouth
U too spoil
What kind of lick
my question be say ,shey una don sex before?
Hmmm
Kontunu to de ask that kind question ooo