You are viewing a single comment's thread from:

RE: Gratitude: Talk Watin make you de Grateful this Year

in #naijapidgin6 years ago

Una good morning ooooo. The thing wey de tutoury my heart this morning be say una give me chance to yan the thing wey de my mind for language wey everybody go understand #naijapidgin as edey my mind na so I wan take yan am
make I first carry tualee go meet baba God because na him make me sleep come wake up this morning,
I wan talk say I de strong gidigba
i de happy for the better better things wey de happen for my life.
Na true say I be Graduate wey just finish and comot for Nigeria captive called service (NYSC) I de wake up every morning say thank-you to baba God bekos say I de alive and sometimes Eget one thing wey de make me vex thatthing be say the thing wey I de write for Steemit no de give me better joy, but I still say oluwa thank you. The area way I de write na mata wey concern relationship and mata wey concern life. In English relationship expert and life couch,
make una Weldon for the better better work way una de do @naijapidgin

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 62102.06
ETH 2415.08
USDT 1.00
SBD 2.49