When you no know wetin to do

in #naijapidgin6 years ago

This life get as ein be. Sometimes, you go reach some kind junction wey you no go fit say how you take reach the place.

When something like that begin happen eh, my brothers and sisters wetin man pikin suppose do? Because my people go say, "jebe ejebe adironma, lawa alawa adironma. But the issue be say, na you carry your two legs waka go enter that kind thing.

As e be say na you go drag wahala for sef, e go good make you take the same way remove the wahala from your head. Anything wey you fit start suppose get finishing o. Drag your head comout there.

Make you stop to dey think say your matter no get solutions. Everything for this life get solution except death. OK na so I go take end today's tori o!

Una rankadede!

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 67321.51
ETH 3513.34
USDT 1.00
SBD 2.83