My NPC entry with @ogoowinner....CREED OF LIFE

in #life7 years ago

Obodo naija elders dem
I dey hail o...
Dis one na my entry for Npc challenge wey @ogoowinner arrange for us with ein church mind

kyrian.jpg
omo na me be that o

Me believe say everybody get right make dem see am, hear am and even love am

I believe say every human being dey equal

I believe say this our world big well well to fit enta every pesin

I still dey believe say everybody na Oga boss for one special area for dis life

I believe say everybody for dis life dey special and unique

I believe say everybody get beast and angel inside dem, So i go dey try my best make i dey supress the beast come dey bring out the angel side

I believe say all dis race, religion and social status no be anytin, na all these people wey wan cause wahala create am make dem use dey control other people, dey cause trouble, and to dey show people say i pass you. So me choose to be "pesin first" before any race,religion abi class.

I go dey treat people the way i go want make dem dey treat me

I no go dey react to people based on wetin dem be , i go dey react based on wetin i want make dem be

I no go shook hand for any business or matter wey go affect anoda pesin badly

I go try dey understand people , no be to dey judge dem

I no go let envy ,jealousy or greediness to dey control wetin i wan do

I must do one tin wey go make humanity beta before i comot dis world

I go try my best to dey dey strong even when dem misfortune, grief and sorrow dey show face

I no fit allow fear to dey intimidate me

I no go dey allow negative thinking to dey enta my mind instead i go just replace am with ones wey dey peaceful and creative because i sabi say "thinking get power"

Me go always be me , my original self. No be anoda pesin photocopy

I believe say i fit make difference if i put my best for any work

I believe say life na journey no be race so me no dey to dey rub shoulder with anybody..no be competition.

Me believe for peace

I believe for charity

I believe for forgiveness

I believe for love

I believe for mercy

I dey believe in justice for everybody

Me believe in our human race

I go dey make decision to dey "live" no be to dey "exist"

Me @kyrian go dey abide by this creed everyday of my life no matter wetin any pesin dey think , dey do or dey talk.

As for you wey don read am,
I dey pray make beta come your way

Have a nice day

Sort:  

Creed of life! I pray make better come your way too o

Nice, I am signing under that Creed of Life too!!

We all would be better persons if we live by it everyday of our lives
Thanks for taking your time to read this.

Coin Marketplace

STEEM 0.17
TRX 0.15
JST 0.029
BTC 56832.31
ETH 2344.40
USDT 1.00
SBD 2.43