The huge explosions of a gas tank in Warri yesterday night | pidgin Version

in Steem4Nigeria2 years ago

Yesterday, me and my friend talk. say make we waka round the street, as e be like say na wetin we dey always do.So we just dey sit for our compound dey talk about Steemit, e nor too tay nai the sky just full with red light everywhere. The thing shock us well-well as we first see am.
I even think say the world don end for my present. The thing really surprise me until I receive phone call from my mama
My parent dey far from where we dey na village dem Dey but them sef feel the explosion for there , Some people dey talk say na bomb, na today we see video of the explosions, I just say make I let una know as I be witness yesterday. I even screenshot am to show una.
Na later we take find out say na Gas tank nai explode oh

C208B03B-DE60-406B-846F-29DF7D277321.jpeg
screenshot of the gas tank when e Dey start to Dey catch fire people many Dey look am self some people even near am self
477CE9EC-F86A-43EB-BF7C-BB67DB0F000D.png
screenshot of the unexpected moment when the gas tank explode I pray body die for inside that explosions because some people Dey close to an well well

F835FCAE-64E8-4952-BBE2-11E4AB249150.jpeg
screenshot of the moment wey the explosions happen even the camera man nor fit with Stand the pressure of the explosions nai he cor Dey run for e life,the thing serious well well oh

That same explosions nai make the full sky change color
Hope this information Dey useful for the steem4nigeria community

Beware ‼️


Beware from this kind stuff nor go close to fire because you see say people Dey there life na sense
Nor play with gas he Dey very dangerous.
Can you imagine say people wey Dey there nobody expect the explosions nai make I say beware

Appreciate all of una wey read this post

Sort:  
 2 years ago 

Omo this your pidgin story no be here ooo.. hahaha! I say make I follow you speak pidgin.

 2 years ago (edited)

We Thank God oh

Thank God for your safety and also be cautious at all times

Thanks for the comment I really appreciate

It's a thing of joy that no one was involved in the gas accident

We thank God

 2 years ago (edited)

No be small thing happen for there ooo! Thank God say nothing happen to una there. Your mama be better mama wey dey care for her pikin as she come call. Hope you tell am say you dey ok? That kind thing fit make person mind fly go far.

Abeg, try learn how to arrange your writing make e no dey dee scatter scatter like this. Na achievement 4 for newcomers community go help you learn that one.

Try also to make your post dey reach 300 words. This one no reach at all.

I am enjoying this pidgin well well. Weldone

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 53921.46
ETH 2250.39
USDT 1.00
SBD 2.30