Thank God for "Dodo"🌚

in #esteem6 years ago

20130305-fried-plantains-mint-mojo-recipe-1-1440xcenter-c-default.jpgsource

My country people o, how una dey for this holiday jolification as we dey celebrate with our muslim brothers and sisters.
I wan bring one mata come una doormot today, this mata na one wey sweet my belle o becos i come see am say God don bless us wella as naija people. I sure say person dey think say wetin i wan talk sef...omo na dodo [plantain] i dey talk about...hehehe.
My pipo one of my padi travel go oyinbo land for Australia side na him the babe tell me say plantain no dey for that side...omo i nearly cry.
I come dey think say wetin i for do if i reach some where wey dodo no dey.
Yes dodo na plantain dem dey call am for english and na better food wey we dey enjoy. We dey chop am with pap, rice, infact anything wey i dey chop plantain suppose dey sef.

Dodo na fried plantain and na one of the food wey be our heritage for here inside naija and na when i come know say no be everywhere plantain dey, i see say God really bless us.

I get one ogbonge question...If i give you 50million Naira make you no chop fried plantain again, you go collect am?

Screenshot_2018-06-16-09-40-35.png

My people we dey blessed say we get our dodo and you fit talk some other way how you dey chop your own.

Today na we first match for this world cup for Russia abeg make we support we super Eagles!


Footnote

If you would like to support us,
Please follow our curation trail Or delegate SP to @naijapidgin account.

We are naijapidgin community with a mission to promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows


Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA

We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On discord we have the following shows and lectures:

  • Real-Life Talk with @preciousimo
    [Tuesdays by 8pm]

  • Lectures on Block chain, Steemit and Cryptocurrencies [Wednesdays by 6pm]

  • Relationship talk with @rosyblessing [Thursdays by 8pm]

  • Variety night show with @itoroarchibong and @imbigdee. [Sundays by 5:30pm]

  • Special Hotseat [Sundays 8pm]

Dont miss it

Naijapodgin Team:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena
@oliverwilliams
@horlaide
@mittymartz
@nmalove
@preciousimo
@rosyblessing


Na @mittymartz design this avatar

Na We Be Naija
Na we Ne Naijapidgin
Na @preciousimo sama una this one

Sort:  

Money dey important abeg

Nice read. I leave an upvote for this article thumbsup

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

I don de salivate for here uhmm

Why i no go collect the money but i go first chop this one wey you put for here first....lol

Omoh dey fry this plantain well o.

I love did too much.

Now wey I dey H na im I com dey see dis wan...iriswel

Damn dodo re oooo

Nicely and creatively written. Bravo

Coin Marketplace

STEEM 0.16
TRX 0.15
JST 0.028
BTC 58642.44
ETH 2294.30
USDT 1.00
SBD 2.44