Gather lever do everything!

in #busy6 years ago (edited)

Una salutation. Dis early mor mor, I just want tell una say ein go good make you gather lever do anything wey you carry for mind to do. No fear anything. Nobody go harm you. Trial no be bad thing. Person wey try fail, better pass person wey no try at all.

Since wey we don dey hear about big big people wey do great things for this world, na so so people wey gather lever try something different wey another person no dey think about at all we dey hear their tori.

Now, wetin you won do? You dey fear say the thing fit fail? You dey fear about the money wey you go carry take start at all? My brothers and sisters fear no more. Just start with anything wey dey your hand now. No wait till you gather everything. Ein go surprise you how things go take work out well. But even if this one no succeed, make you no cry too much come give up, continue to dey get lever try different things until you hammar.

Una Weldon o!

Sort:  

To get upvote from @wafrica, the post needs at least 300 characters! Please describe your work in detail ;-)

Coin Marketplace

STEEM 0.21
TRX 0.13
JST 0.030
BTC 67167.83
ETH 3499.47
USDT 1.00
SBD 2.81