Man no suppose to cook

in #busy6 years ago

PicsArt_11-07-02.51.03.jpg

Uganda President just make himself trendy for African social media recently o! Him say man no suppose to dey cook. In fact, him talk say, man no suppose to dey enter kitchen.

My dear readers how una see dis matter?

Ein supposed to talk dat kind of thing?

All of us know say na African mentality dey worry am, but why him go want to hold on to some past when some things don change?

We know say before for African history man no dey cook, but that one dey happen when men dey supply all the needs for the family. These days both the man and the woman dey go out together go find money for the family, how the man go expect her to dey do all the house chores alone? No be wickedness?

Who tell dem say women no dey tire? How two people wey don work tire for office go come back from work, one go begin house work while the other one go sidon dey rest? Even if him no sabi cook, make him help her out for kitchen.

Anyways, I thank God say most African men no dey behave like dat again, because I remember say when I small, if my mama too busy for shop, my father dey enter kitchen cook delicious food for us.

So me I totally disagree with the statement say men no suppose to dey enter kitchen. If you love your wife, you go dey pity her small. You no go see her like your house help.

I don write finish for now. I salute una.

Coin Marketplace

STEEM 0.13
TRX 0.24
JST 0.030
BTC 82004.32
ETH 1554.83
USDT 1.00
SBD 0.76