TOMORROW

in GEMS5 years ago


the story is written in pidgin enlish.

Chinedu just come back from Malé(Maylesa) with new benz. O boy! The thing shock me! I still dey reason last night cruise,my head still dey headache. Omo! E be things! See flex my guy, see flex! Baba spend six figures in one sitting. Booze dey flow like water, mama dey like mtn--everywhere you go. I shak so tey my eye close. Damn!

Chinedu na my boy that year oo. Na me dey give am small small work wey him dey do that year to help hold body and soul since him people no too hold like that. Now baba don move from ajegunle to ikoyi. Baba buy house for banana Island. Banana fucking island! Banana island wey me never even see with my eye before. Omo! E be things.

"Na God,my brother"

Na wetin Chinedu tell me when I ask am how him take make am. Him and I know say God no dey give person that kind money. The last person wey him give that money wey be Solomon, him later dey talk in the nonsense. So I suppose say BaBa God don learn him lesson.

Anabel our area gossip talk say Chinedu sell him kidney.

You dey whine me ni? How much be kidney?!

Kidney no fit give you that kind money. Even sef, me no fit sell my kidney. The way I dey drink these days, I for fit need that extra kidney for later.

I hear from him right hand man say Chinedu be drugee(drug dealer). That one make sense but me no fit do drugs oo. Wetin my eye don see on top El Chapo matter, I no fit try am. Those people their heart dey their nyash. Me no fit die for sará.

E be like say na poverty suit me because na the only cloth me mind fit wear. Baba God tailor get my measurement well well. But this life no balance. See as my guy take dey use money wey fit change my life dey cruise oo. Baba no even gree give me t-fare. Na my leg I take reach house that night. Men! SARS em hold me for road. I call Chinedu but him no even reason my matter. Na two days now I don dey this cell but no be the one wey dey worry me now. The thing be say this na the last suffer I won suffer for this life. After I comot from this cell I must jam money or danfo go jam me. Na the only way be that coz as you see me so, I don tire for suffer head. This life no balance!

My Mama(babe) don dey reason me say she won marry. Na on top this minimum wage wey we go start family? Reason am. Ko le make sense. Is not a sensible something.

"I want to have your babies."

Shey this one dey mad ni?! Babies ko Babylon ni. I be like person wey fit give woman bellé? That one no be double wahala I won carry on top my head like that. She com dey talk say she be hot cake say other niggas dey wey dey reason am. Na me come be left over beans? Oya na. E go be. Me I know say I be golden boy! I no dey rush. Make she dey go. Funds go soon dey, on God! Wo! This lagos no go hear word. I go paint this state red blue and indigo, their papa! Even that her mama wey dey do like winch go bow. I know say na she dey pressure my mama. Girl wey like me choke, she won come put sand for my gari. Na ogun go finish her papa.

I know say all these vex na on top say I no hold bar. If small money just touch me,I know say everywhere go stew but when Baba God, When? Boys don dey old. No shame us abeg. I don dey hustle, I dey play my part, no put me to shame. This country hard. E hard choke! Make man no go put hand for wetin dem no suppose put hand. Na only me my mama born. Baba reason this woman, no look my side sef. She don try for me. I know as e be when I dey grow. All the sacrifices wey she make untop say make I be better person for life. I dey try uphold all them values she teach but e hard,I no go lie. Well, na your hand I dey Baba God.

Na so I go sleep for here again. Na ogun go kill Chinedu. Long throat no good oo. I for just dey dey sip my alomo codedly instead of this shame wey I dey face. I no thief, I no do anything but I dey olopa station. This life no balance.


Image source: https://pixabay.com/images/id-4672485/

Posted using Dapplr

Coin Marketplace

STEEM 0.11
TRX 0.24
JST 0.031
BTC 79842.17
ETH 1572.50
USDT 1.00
SBD 0.64